25.9 C
Lagos
Saturday, November 23, 2024

Sunday Igboho cancels Lagos after attack on home leads to two deaths, wife’s abduction

Must read

Sunday Igboho cancel Lagos rally, narrate how men in ‘soja uniform’ attack im Ibadan house

By BBC Pidgin

Yoruba activist Sunday Adeyemo wey many pipo sabi as Sunday Igboho don cancel im plan to rally for Lagos on Saturday afta im house come under attack on Thursday morning for Ibadan, Oyo state Nigeria.

Igboho tell BBC Pidgin say, two pipo die and several others still dey miss afta unknown men wey wear military uniform enta im house for Soka area.

Afta series of rallies for different part of states for di south west, Igboho suppose lead rally for Lagos on Saturday, but e say dat don cancel now becos e no dey safe and im need to dey safe.

How di attack happun

Sunday Igboho tell BBC pidgin say di attack happun early mor-mor.

“I dey my house around 1:30am” I just hear gunshot for front of my house and shout say, we be DSS, we be soja, Sunday Igboho come out

I peep through my window, I see dem, dressed in DSS and Nigerian army uniform. I dey surprised say wetin be di problem, becos I no kill anybody, e tok.

Di activist say di tin come as surprise to am becos im activism na for di safety of im pipo and e dey violence free.

“Wetin I dey do na to fight for my pipo, my rally dey peaceful, I fight for my family becos Fulani bandits kill my family, rape dem. goment refuse to do di right tin for my family dat na why I come out to fight for dem so I dey surprised.

“Dem kill two pipo during di shooting, dem destroy my property, my vehicles”, e tok.

Wen BBC Yoruba visit di house afta di attack, blood dey for di entrance of di door wey lead to di main house and for some oda parts of di building.

Di unknown gunmen destroy im cars, some of di cars get bullet holes. Dem scata things for di house.

Bullets dey for ground, di pestle dem use break door to enta too dey ground.

Dis no be di first time, Sunday Igboho house dey come under attack.

Meanwhile BBC Pidgin call di Oyo state police command to confam di incident, di Commissioner of Police, Ngozi Onadeko say she no dey aware but go expect make di public relations officer brief her if such tin later.

Dis attack dey come hours to di mega rally for di call of “Yoruba Nation” wey dem dey plan for Lagos state dis weekend.

Reactions from di leader of di Umbrella Body of Yoruba Self-Determination Groups, Ilana Omo Oodua (IOO), Professor Banji Akintoye

Di leader of di Umbrella Body of Yoruba Self-Determination Groups, Ilana Omo Oodua (IOO), Professor Banji Akintoye, don react to reports of di invasion of Igboho house for Ibadan.

For inside statement, e allege say na Nigerian Army and International Terrorists wey Nigeria goment hire carry out di attack.

According to Professor Akintoye, e claim say di attackers speak French and dem carry di deadi bodi of pipo wey dem kill and dos wey dem carry alive, wey include di wiife of Chief Igboho.

Di Oodua movement leader condemn di attack say e dey “unfortunate, wicked, callous, cruel, irresponsible, illegal and atrocious.”

E call on Yoruba pipo for di kontri and all ova di world to begin mass protest for di offices of di United Nations, European Union, British, French and United States Governments.

E confam again say dem dey go ahead wit di Pro-Yoruba Nation rally wey dey scheduled to hold on Saturday July 3rd for Lagos.

Di demand for Yoruba Nation

Di Yoruba activist, Sunday Igboho don dey go across di South-West geopolitical zone to campaign make di south west states separate from Nigeria to stand alone.

E say dis don become necessary sake of di injustice di pipo of di region and di insecurity wey dey grow worse for di kontri.

Timeline of Sunday Igboho attack

Thursday attack na one of di many reported attacks on Igboho and im Ibadan house since January 2021 wen e issue seven-day ultimatum to killer herders for Ibarapa area of Oyo State.

On January 26, 2021, report say some faceless hoodlums attack di Soka residence of Igboho for Ibadan and burn di house.

For February 26 2021, Kasala burst along Lagos-Ibadan expressway on Friday as police and Department of State Services allegedly try to arrest di Yoruba activist.

Tori be say Sunday Igboho bin go meet Yoruba socio-political group, Afenifere chief, Ayo Adebanjo wen di kasala burst

More articles

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Related articles

Who wan die?